According to Godwin Laya, wey be di victim’s relative, “E admit say e kill my sister, Felicia, e say na sometin enter im eye make e kill am. E accuse im mama say she do juju on am.
By Akpoguma Tejiri:
Di former Vice Chairman of Okolor Inland community, Udu Local Government Area for Delta state, Austin Ejovwo, wey dem catch, tok say na evil spirit make e kill im lover, Felicia Akpomeria.
Dis tori na as Delta State Police Public Relations Officer, DSP Bright Edafe, for telephone tok say dem go carry di suspect go court soon.
According to tori wey we hear from family sources, Ejovwo run enter Ologbo bush go see one of im relative afta e commit di crime.
Dem find Felicia dead for di lover’s bedroom apartment with blood all ova her bodi from matchet wounds on Friday.
According to Godwin Laya, wey be di victim’s relative, “E admit say e kill my sister, Felicia, e say na sometin enter im eye make e kill am. E accuse im mama say she do juju on am.
“I believe say di person wey kill am dey try cover im real reason for killin our sister. E admit for Ovwian Police Division, wey dem first detain am, say e dey owe our sister.
“For us, no spirit push am. We hear say e don kill person before. E dey into occultic tins. E either kill our sister for rituals or to avoid pay her di money wey e dey owe am.
“E run go im sister place wey dem dey produce palm oil, and because of im behavior, di sister wan carry am come back to di village before dem call her say her brother don kill woman.
“Na im sister carry am go Ovwian police station afta dem inform am. If dem bin call us before dem carry am go police station, if dem bring am give us, we for take revenge for our sister’s death because we dey vex.
“Government suppose ensure say justice dey serve on di suspect. “Dis man na suspected ritualist because our sister body dey near shrine for inside di house, although police no allow me see my sister bodi for mortuary.”