Make una remember say di Revenue Mobilisation, Allocation and Fiscal Commission don recommend say make dem increase di basic salaries of those wey dey hold judicial and political office.
By Akpoguma Tejiri
Socia-Economic Rights and Accountability Project don talk say dem go carry Presido Bola Tinubu administration go court sake of di kasala wey dey for di proposed salary increase wey dem wan give big big government people.
SERAP yan dis one for tweet for Twitter.
Dem talk say, “We go carry Tinubu administration go court sake of di way wey dem increase di salary of Presido, vice presido, state governors and lawmakers by 114 per cent wey no be legal thing, meanwhile we get over 133 million Nigerians wey dey live for serious poverty.”
Make una remember say di Revenue Mobilisation, Allocation and Fiscal Commission don recommend say make dem increase di basic salaries of those wey dey hold judicial and political office.
Alhaji Muhammadu Shehu, wey be di Chairman of di commission, wey dem represent by Mrs Rakiya Tanko-Ayuba, RMAFC commissioner from Kebbi State, yan dis tori for Tuesday for Birnin Kebb, wey be di capital of Kebbi State, when dem dey present di reviewed remuneration package of political and judicial office holders give di Kebbi State Governor, Dr Nasir Idris.
People don describe di proposed increase for salary as “outrageous,” sake of say we get over 133 million Nigerians wey dey suffer for serious poverty.
Di proposed salaries go favour Presido, im vice presido, lawmakers, judges, and di 36 state governors.