SPORTS

Chelsea Owners Don Buy French Ligue 1 Club Strasbourg

Fans bin dey fear say Strasbourg, wey declare bankruptcy for 2011 and demote go fifth division, go just turn farm team for Chelsea.

By Akpoguma Tejiri:

Di American owners dem wey dey control English Premier League giant Chelsea don sign agreement on Thursday to take control of French Ligue 1 outfit Strasbourg.

“For inside dis agreement, e mean say e don open new chapter for Strasbourg as the consortium don commit to dey speed up investments wey go help grow di club,” BlueCo consortium yan inside statement. “Dis one include investments for di first team and academy, to continue di project wey Marc Keller start, wey go still make am remain as chairman of di club, wit support from im current management team.”

Di consortium wey dey led by American businessman Todd Boehly and Clearlake Capital wey dey based for US bin get tough time for di first year wey dem take control Chelsea.

Dem sack managers Thomas Tuchel and Graham Potter before dem finish di season wey no good under interim boss Frank Lampard.

Chelsea finish for 12th position, wey be dia worst position since 1994, even after dem spend pass £500 million ($624 million) to buy new players for di first two transfer windows under di new owners.

Dem don later hire Mauricio Pochettino as dia new coach.

Strasbourg bin also get dia own wahala for di last season, as dem finish just two positions and five points above di relegation zone.

Dem bin finish for sixth position just 12 months before.

One person wey dey inside di matter tell AFP say di US consortium don buy almost all di shares for Strasbourg club.

But, e no fit yan di total value of di deal. “We don build one healthy, well-managed club for all levels.

“But we know say we don reach di limit of our model, and if we wan continue to push di club enter new level, we must get strong structure wey go fit support our development and ambition.”

E add: “So I dey happy say new strategic investor don show up, wey go help us speed up di ambition to build di Strasbourg of tomorrow.”

One person for inside di club yan say dia no go get any connection with Chelsea. “Dey go get common shareholder but separate sports departments. Dem fit work together but e no go be di main thing.”

Fans bin dey fear say Strasbourg, wey declare bankruptcy for 2011 and demote go fifth division, go just turn farm team for Chelsea.

“Di new majority shareholders dey invest for Marc Keller project to give am di necessary support make e progress,” di source add.

“If Strasbourg no do anything, di club go drop for di hierarchy. So we must take action now to make sure say di club maintain im position.”

Related posts

Four Nations Qualify For Euro 2024 (Full List)

Waffi Tv

Transfer: Man Utd Agree Deal To sign Hojlund

Waffi Tv

Six-Star Arsenal Blow Away Helpless Sheffield United

Waffi Tv

Leave a Comment