NEWS

Gunmen Don kill Three Miners For Plateau

Mr Rwang Tengwong, di National Publicity Secretary of Berom Youth Movement, one socio-cultural group, don confirm di matta on Friday for Jos.

By Akpoguma Tejiri:

Gunmen don kill three pipo on Friday for one mining site wey dey Tanjol for Jol community for Riyom Local Government Area for Plateau State.

Mr Rwang Tengwong, di National Publicity Secretary of Berom Youth Movement, one socio-cultural group, don confirm di matta on Friday for Jos.

According to Tengwong, di thing happun around 11 a.m.

He talk say two other pipo wound for di attack.

“For around 11 a.m., gunmen don kill three pipo and wound two others for one mining site for Tanjol area of Jol community for Riyom.

Di pipo wey wound dey receive treatment for one hospital for di area,” he tok.

Tengwong, wey describe di attack as too many, dey call on government and security agencies make dem put eye for di safety of pipo and property for rural areas.

Mr Alfred Alabo, Public Relations Officer of di Police Command for Plateau, no pick di call wey dem make to im line, but one top Police officer don confirm di attack.

Related posts

Surgeons Perform Second Historic Pig-To-Human Heart Transplant

Waffi Tv

Hardship: Senate Asks FG To Give Low-Earners Food Vouchers

Waffi Tv

Niger Coup: ECOWAS Leaders To Meet On Thursday

Waffi Tv

Leave a Comment