NEWS

Titanic Sub Operator Tok Say All Passengers Don Sadly Kpuff

Dis small tourist submarine bin loss since Sunday, for inside one big part of di North Atlantic wey dey between di surface of di ocean and more than two miles (almost four kilometers) below.

By Akpoguma Tejiri:

The operator of one kin submarine wey miss near di place wey Titanic sink talk say on Thursday dem believe say all di five pipo wey dey inside don die. Di Coast Guard yan say di submarine bin kpafuka inside di ocean deep inside one “catastrophic” implosion.

Oceangate yan dis one afta dem talk say dem don discover “debris field” as rescuers bin dey search for days. Dis tori come add fear say, even if di submarine still dey intact, e fit don run out of oxygen.

“Right now, we believe say our CEO Stockton Rush, Shahzada Dawood and im son Suleman Dawood, Hamish Harding, and Paul-Henri Nargeolet, don die,” Oceangate yan for one statement.

“Dem men bin be true explorers wey get spirit of adventure, and dem get passion to explore and protect di world oceans,” dem add.

“Di loss of dia lives and di joy wey dem bring to pipo wey know dem, dey pain us well-well,” dem conclude.

Di US Coast Guard yan say di debris dey consistent with di “catastrophic implosion” of di submarine.

Dis small tourist submarine bin loss since Sunday, for inside one big part of di North Atlantic wey dey between di surface of di ocean and more than two miles (almost four kilometers) below.

Inside di submarine, dem bin get British billionaire Harding and two pipo wey be Pakistani-British citizens wey be Dawood and im son Suleman. OceanGate Expeditions dey charge $250,000 for one seat for di submarine.

Na OceanGate CEO Rush and French submarine opareshon pesin Nargeolet, wey dem dey call “Mr Titanic” sake of im many dives for di place, dey inside di submarine.

Marine scientist and oceanographer David Mearns, wey be expert for deep water search and recovery, bin talk say di discovery of debris mean say di submarine don break.

“Di only thing wey dey save na say di breaking fit don happen sharp sharp, within milliseconds, and di men no go sabi wetin dey happun,” Mearns yan. Im bin be friend to two of di pipo wey dey inside di submarine.

Many assets and experts bin join di search operation for di last day, including two more Remotely Operated Vehicles (ROVs).

French research ship Atalante don send robot wey go fit search for up to 6,000 meters (almost 20,000 feet) below water on Thursday, di US Coast Guard tweet.

Di 21-foot (6.5-meter) Titan submarine bin start to go down by 8:00 am on Sunday and e bin suppose resurface seven hours later.

But e bin lose communication with im main ship less than two hours into di journey wey e take go see Titanic.

Ships and planes bin search 10,000 square miles (around 20,000 square kilometers) of water — di size na like di US state of Massachusetts — sake of di submarine.

Di place wey Titanic sink dey 400 miles off di coast of Newfoundland, Canada, and e dey more than two miles below di surface of di North Atlantic.

Titanic bin hit iceberg for 1912 and e sink during im first journey from England go New York with 2,224 pipo inside. More than 1,500 pipo die.

Dem discover am for 1985 and e still dey attract experts wey like nautical tori and tourists wey like go underwater.

Di pressure for dat deep na like 400 times pass wetin dey for sea level.

For 2018, one former director of marine operations for OceanGate Expeditions, David Lochridge, yan for one court case say dem fire am sake of im complain about di “experimental and untested design” of Titan.

Related posts

PDP Govs Meet To Discuss State Of Party, Nation, Others

Waffi Tv

Officers On Stop And Search Duties Must Be In Uniform- Force PRO

Waffi Tv

Tinubu’s Broadcast Waste Of Time, Deceptive- Atiku’s Aide

Waffi Tv

Leave a Comment