Waffi TV remember say labour unions bin propose N200,000 as di minimum wage to di President.
By Akpoguma Tejiri:
Di gubernatorial candidate of New Nigeria People’s Party (NNPP) for di last general elections for Ogun State, Ambassador Olufemi Ajadi Oguntoyinbo, don beg di federal government wey President Bola Ahmed Tinubu dey lead make dem gree to di N200,000 minimum wage for workers across di whole kontri.
Oguntoyinbo talk say e dey important sake of di present economic reality wey don make prices of goods and services for di kontri increase.
E talk dis tory for one statement wey e give DAILY POST on Saturday.
Waffi TV remember say labour unions bin propose N200,000 as di minimum wage to di President.
But Oguntoyinbo come beg Tinubu make e gree to di request.
Di NNPP candidate for di statement talk say e dey pain am say di people wey dey collect small salary dey suffer for dis harsh economic reality, and say like 120 million citizens dey live for poverty.
E explain say di best way to reduce di suffer wey workers dey face na to gree to di N200,000 minimum wage request.
E add say e dey appeal based on di present economic reality for di kontri.
E talk say Tinubu and di governors suppose find ways to listen and approve di request from di workers.
“E dey important make President Tinubu and governors sit down, calculate well and think about di minimum wage so e go reflect di current reality for di kontri, by make workers collect beta salary wey go fit cover di cost of food and oda essential things wey dem need.
“All di elected leaders suppose use di opportunity wey dem get as leaders among millions of Nigerians to make difference for di life of people, by create environment wey go allow all Nigerians irrespective of how much dem dey earn to dey comfortable.
“I wan take dis opportunity beg our President, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu and di 36 state governors make dem make di welfare of workers and ordinary citizens dia priority by obey di 200 thousand naira minimum wage instead of increase dia own pay.”