Real Warri Pikin, wey yan dis tori give media pesin, Chude Jideonwo, yan say she don dedicate herself to serve God.
By Vincent Ebiowou:
Popular comedienne, Anita Alaire Afoke Asuoha, wey people sabi wella as Real Warri Pikin, don talk say after her boyfriend for university scatter her heart, she come decide say she no go do ‘chop and clean mouth’ with any man again till her wedding night.
The mama wey get three pikin talk say she swear say no man go see her ‘nakɛdnɛss’ again until her wedding night after the heartbreak.
Real Warri Pikin, wey yan dis tori give media pesin, Chude Jideonwo, yan say she don dedicate herself to serve God.
She talk say, “E get one boy wey break my heart [when I dey university], I come give my life to Christ. I talk say, you know wetin? I no dey do men again. I go serve God.
“I begin dey serve God and dey go church, dey pray for campus. I stop to dey go party. And I become celibate. I swear say no man go see my nakɛdnɛss again till my wedding night.”
She talk say she meet her husband, Ikechukwu, during her NYSC for Abuja and dem marry for 2012.