Life StyleNEWS

Twin Sisters Machete Dia Senior Brother To Death For Calabar

.…..brother comot for house go one lonely place, come use machetes attack am.

By Akpoguma Tejiri: 

Police for Calabar don arrest twin sisters wey dem talk say dem chop dem senior brother wit machetes sake of say him sell dia late papa land and no wan share the money wit dem.

Dem identify di twins as Ikwo Effiong and Idak Effiong. Dem talk say di twins kill dia elder brother, Kokoette Effiong, sake of say him sell dia papa land wey dey Ikot Nakanda, for di Akpabuyo Local Government area, and no wan give dem dia own share for di money.

Dem talk say di twins bin deceive dia elder brother comot for house go one lonely place, come use machetes attack am.

“One sell dia papa land for Ikot Nakanda and come decide to chop all di money alone without gree share wit oda family members and e vex di twins, wey come decide to attack am with knife,” na wetin one pesin wey dey related to di family, Otop Idebe, talk.

Dem talk say di twins tok say dem brother don sell part of di land before and no gree give dem anything from am, and di second time wey e sell again without gree share di money na him make dem vex reach to kill am.

Otop Idebe, wey na Kokoette cousin, talk say di twins bin beg dia elder brother make e share di money wit dem, but when e no gree, dem con follow am comot from house, come attack am, wound am for head and arm, wey make am bleed die.

Ms Irene Ugbo, wey be di spokesperson for Cross River Police Command, talk say dem don kpokpo di twin sisters.

Related posts

There Is No Rivalry Between DSS And EFCC- Former DSS Director

Waffi Tv

Chicago Varsity Says Tinubu Attended School And Graduated 1979

Waffi Tv

Man, Son, 3 Others Die In US House Explosion

Waffi Tv

Leave a Comment