Life StyleUncategorized

Akwa Ibom: Man Sell im 9-Year-Old Pikin For N400,000

……Relations Officer for the state, talk dis one for statement wey dem give newsmen for Uyo.

By Akpoguma Tejiri: 

OPERATIVES dem for Quick Intervention Squad, QIS, Akwa Ibom State Police Command, don catch one Gabriel Okon Ekpiri of Ekit Itam Akpan Obong wey dey for Itu Local Government Area. The man bin sell im nine-year-old pikin for N400,000.

Mr. Odiko MacDon, wey be Police Public Relations Officer for the state, talk dis one for statement wey dem give newsmen for Uyo.

MacDon still talk say the Commissioner of Police for the state, Mr. Olatoye Durosinmi, on Monday, don decorate two Deputy Commissioners of Police wey dey work for the Command.

Im talk say, “The two Deputy Commissioners of Police na DCP Baba Lawan Audu, wey be Area Commander for Eket Area Command, and DCP Lawal Isa Mani wey dey for Department of Operations.

“The CP, as him dey give hearty congratulations from Inspector General of Police, Acting IGP Olukayode Egbetokun, tell the officers make dem double their work rate as dem dey support their superiors.

The senior officers wey happy thank the Police Service Commission and Inspector General of Police for promoting them. Dem still thank the CP for im hard work and how him dey take care of dem and the officers and men for the Command.

“On top another matter, the CP don condemn the action of Gabriel Okon Ekpiri wey dey Ekit Itam Akpan Obong for Itu Local Government Area. The man sell im nine (9) years old pikin for four hundred thousand (400,000) naira.

“The CP talk say the action dey barbaric and e no good at all. The suspect wey Quick Intervention Squad for the Command catch don confess say na devil and economic wahala make am do the thing.”

Related posts

Delta: Gunmen Kill Kidnapped 60-Year-Old Woman After Collecting N1m Ransom

Waffi Tv

Yahoo boy Jailed After Failing To Account For N6m In Bank

Waffi Tv

I Almost Became a Pastor, Tonto Dikeh Reveals

Waffi Tv

Leave a Comment