ENTERTAINMENT

I Be Fornicator, I Nor Be Adulterer, Davido Look like Person Wey Don Marry- Anita Open Up

Davido, wey don marry Chioma Rowland, get plenti pikin with oda women.

By Vincent Ogaga:

Singer Davido entangled for anoda baby-mama gbege, as US-based woman wey dem dey call Anita Brown talk say him impregnate am and tell am say make she commot am. She come share screenshots of their chats to support her claim.

Brown still talk say she no sabi say Davido don marry and dem even ask am make she lie say hackers bin hack her account when she first talk about the matter.

Davido, wey don marry Chioma Rowland, get plenti pikin with oda women.

Miss Brown, for one video wey she share, do pregnancy test wey show say she dey carry belle, come talk say Davido cousin, Clarks Adeleke, dey ask am wetin she want make she do about the belle.

For her talk, “Wetin dey pain me pass na this tori say na married man una dey carry dey yan, make una stop am. I no know say him don marry, I swear. Make una go him page, him look like person wey don marry? I dey confused. Make we even commot matter of the pikin, people know say I carry belle but nobody know say him don marry. I dey America, nobody here sabi, sorry. No dey for blog, e no dey popular, if man no talk, me no go know. I no dey look for husband, e no dey my agenda for now, so I no dey find that one, I no dey dig anytin like that. So no, I no know. I bin find out afta the matter and come find out say I bin don carry belle. Una for calm down, maybe I be fornicator but I no be adulterer, make una relax.”

Related posts

Mr Macaroni Calls For Release Of Detained EndSARS Protesters

Waffi Tv

We’ve Received 1,500 Applications From Nigerians In Two Months – Guinness World Records

Waffi Tv

I Found Mohbad’s Body Embalmed By Staircase- Father

Waffi Tv

Leave a Comment