ENTERTAINMENT

I Nor Dey Shame About My Past- Anita Brown Yan As She React To Tori Wey Say she be Porn Star

She talk say as person wey believe, e no good make people shame others based on wetin dem do for di past…..

By Vincent Ogaga: 

US-based lady, Anita Brown, wey dem talk say Davido carry bele for don tok about di tori wey dey fly upandan say she na porn star.

Wen she enta social media, for di series of tweets, di American woman talk say di tori wey dem dey spread say she be porn star no true at all. She come yan say di videos wey dem dey share for social media na videos of her and her ex-boyfriend.

She talk say as person wey believe, e no good make people shame others based on wetin dem do for di past.

“Make persin wey never commit sin throw di first stone. E good make people fit grow. E good make people fit change,” she write.

“I love who I be for di past and I still love who I dey become and where I dey reach so far. Di things wey I don do for di past and di things wey I don waka through don give me authority and testimony. I no dey shame about my past. I be light.

“If you be believer, you no go shame person based on im past. Na so Christianity suppose be. Na so New Testament suppose be. Redemption, salvation, faith. Turn pain to purpose.

“Life don change. Even my pikin papa talk am. Na so life dey go, dey elevate. E for no get much power if I be di same person since from beginning.

“For anybody wey talk say celebrities no dey sleep with porn stars… babe, Drakes baby mama na porn star and dem dey enjoy each other and he love im pikin well well. (Sidebar; e no get anything to do with me, na example I just yan) so make una calm down.

“No ever play with my name dey talk porn star. E no true at all. Any video wey una go see of me na probably when I dey with my ex years ago. Abeg, get over am! Nextttttttt!

“No be anything fit make dem talk wey I no fit accept! I no owe una anything because una no be God.”

Related posts

WizKid’s ‘Made In Lagos’ Hits US Best-Selling African Album Record

Waffi Tv

Why We Quickly Buried Mohbad- Father

Waffi Tv

Coup: ECOWAS Can Send Me As Peace Offering To Ibrahim Traore- Cossy Ojiakor

Waffi Tv

Leave a Comment