E explain say plenty visitors don dey waka come visit am for im hometown wey be Daura.
By Akpoguma Tejiri:
Former Presido Muhammadu Buhari don yan why e comot from Daura for Katsina State go London.
Buhari talk say e waka comot from Daura go London sake of e wan stay for one place wey quiet.
E explain say plenty visitors don dey waka come visit am for im hometown wey be Daura.
One statement wey Buhari former media aide, Garba Shehu, write talk say: “E decide say make e go house for Daura dey hope say e go see quiet wey e dey find for imself, but e come realize say e no be so, visitors dey come waka morning, afternoon, and night, so e carry imsef comot go one place wey far.
Na im wish say make dem allow am get im rest wey e need, and make the Tinubu government create the right atmosphere make dem fit work on top the promises wey dem promise.”
After e finish im presidency, Buhari return go im hometown wey be Daura.
But Presido come commot from Nigeria go London, after wey e meet with Presido Bola Tinubu.