E tok dis one wen e dey do im weekly mass for church and e add sey e no bad if pesin wan drink alcohol, but e must dey do am small small……
By Vincent Ogaga:
Rev Fr Chinenye Oluoma, wey pipo dey call am Fada Oluoma, don tok say na God create alcohol for pesin to drink and e get medicinal value.
E tok dis one wen e dey do im weekly mass for church and e add sey e no bad if pesin wan drink alcohol, but e must dey do am small small.
The Catholic priest use one verse from Bible take support im talk sey na God approve am.
Oluoma come remind di congregation sey St. Paul bin tell Timothy sey make e drink wine sake of say e go helep am take solve im ulcer wahala.
E say everytin wey God create suppose make pesin take am small small to gain di benefits and alcohol no be exception.
Fr Oluoma tok sey, “Whether you like am or not, alcohol get medicinal value, na God create am. St. Paul tell Timothy sey ‘Take am sake of say e get medicinal value.'”
“Why St. Paul no tell Timothy sey ‘Go pray make your ulcer go. Get faith for God, e don promise us divine healing.'”
“E sey ‘take alcohol, drink wine’. Everytin wey God create, na like wine, if you drink am as you suppose dey, e go helep you.”
“So all of una wey like drink wine, abeg drink am, but na small small.”